I Don Promise Woman House Before Make She Give Me Sex – Orezi

I Don Promise Woman House Before Make She Give Me Sex – Orezi

Nigerian singer, Orezi, don confess say e promise one babe house before, but e no fulfil am.

E talk dis one for recent interview with Echo Room, as e react to di Lamborghini wahala between Grammy winner Burna Boy and socialite Sophia Egbueje.

Orezi say e no see anything wrong if men no fit keep promises to women, because women too dey break promise to stay faithful.

E talk say, “I no be part of di Lamborghini boys. I never promise any babe something wey reach N300 million. I dey craze?

I don promise one babe house before, but I no fulfil am. Why I go buy house for woman? For wetin? Women too dey promise say dem go stay loyal, but dem dey fail. So make everybody dey promise dey go. Na survival of the fittest [laughs].”

Posted in Entertainment, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *