I Lose My Eye Small After I Smoke With Snoop Dogg – Ed Sheeran

I Lose My Eye Small After I Smoke With Snoop Dogg – Ed Sheeran

British singer, Ed Sheeran don talk say one time like dat, he lose him eye small (temporary blindness) after he smoke with American rap legend, Snoop Dogg.

Di ‘Shape Of You’ crooner yarn dis tori for him TikTok page recently.

For di video wey he post, Snoop Dogg dey seen dey roll something wey resemble weed, and Ed caption am: “Last time I smoked with Snoop I lost my ability to see.”

Last year, Snoop Dogg bin ginger him fans when he say he dey “give up smoking,” but e later clear up say na smoky stove he dey talk about, no be weed.

Ed Sheeran don also talk before say Nigerian singer, Burna Boy, na one of di heaviest weed smokers wey he don ever work with.

Both of dem don do songs together like ‘Own It’ with Stormzy wey go number 1 for UK, and ‘For My Hand’ for Burna Boy ‘Love, Damini’ album.

Posted in Entertainment, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *