Di audio wey social media critic, VeryDarkMan, share, talk say Nedu get connection with people wey dey do illegal business for Turkey, South Africa, and Morocco.
Very dark man files petition against Nedu, asks the South African Embassy and Moroccan embassy to investigate him on drug dealing and fraud😭🧎🏻♂️➡️🙆🏼♂️ pic.twitter.com/4D7YepPMNX
— Oyindamola🙄 (@dammiedammie35) February 26, 2025
VeryDarkMan even carry di matter go embassies of South Africa and Morocco for Nigeria, as e submit petition against Nedu.
For response wey Nedu post for im Instagram story, e deny di allegations, talk say e no sabi anything about di voice note and e never do any criminal activity before.
“Hello, everybody. Dis mata don pass play. I no sabi anything about di voice note wey dey go round. No be me do di voice note. Even though e be like say na joke, I never and I no go ever join anything wey get to do with crime,” Nedu write.

I No Dey Involved For Any Illegal Act – Nedu Deny VDM Allegations