Former presidential candidate of di African Action Congress, Omoyele Sowore, don challenge Nigeria Police Force and Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) officials wey stop am from entering Federal High Court premises.
Sowore tell di officers say e no be former Kogi State governor, Yahaya Bello, wey EFCC dey investigate for alleged financial misappropriation.
Di ex-AAC presidential candidate, wey be human rights activist, no gree make di officers block am.
For one video wey e post for him X handle, Sowore talk say Nigeria justice system don dey controlled by uniform security agents, including DSS, police, and civil defence.
E claim say dem don take over di court premises illegally because dem carry “thief,” Yahaya Bello, come court.
Sowore still blast di authorities say dem no arrest Bello when EFCC declare am wanted, but na only when di former governor report himself for EFCC office for Abuja dem fit detain am.
For di video, Sowore talk say, “Why you dey shout for me? I resemble Yahaya Bello? I get business for court. I no need police or EFCC clearance because none of una be court officer.
“Dis na Federal High Court, bring court official make I talk to dem. EFCC carry me come court, dem still dey harass us. You no get right to stand for high court front. You no be my lawyer and you no get right to know my case.”
No be today Sowore dey get wahala with security personnel.
Recently, di human rights activist talk say Nigeria Police Force dey plan to detain am because e criticize di extension of Inspector-General of Police Kayode Egbetokun tenure.
Sowore reach di Force Intelligence Headquarters by 9:58 am after police invite am, sake of say e post viral video wey talk say police officers dey extort people for one checkpoint for Lagos.
Di activist bin go answer different allegations, including say e resist and obstruct public officers, disobey lawful orders, cyberstalking, and acts wey dem talk say e use try prevent arrest.
For one Facebook post, Sowore talk say di police dey rely on “old gist” wey dem gather from internet to question am.
The justice system in Nigeria has been hijacked by uniformed, uncouth security agents ranging from @OfficialDSSNG, @PoliceNG, and @CivilDefenceNGR. Today, they mounted illegally in front of the court, harassing everybody because of a thief, Yahaya Bello @officialgybkogi. The same… pic.twitter.com/7FmJ8lYXOa
— Omoyele Sowore (@YeleSowore) February 24, 2025