Di former Governor of Kaduna State, Nasir El-Rufai, don talk say e comot for di ruling All Progressives Congress (APC) wit di full knowledge of former President Muhammadu Buhari.
Reports talk say El-Rufai, wey be one of di founding members of APC, waka enter Social Democratic Party (SDP) on Monday, sake of di way tins dey go for di party.
As e dey yarn for interview wit BBC Hausa on Wednesday, di former governor talk say e don discuss wit Buhari before e decide to leave APC go join SDP.
E say, “I comot for APC wit Buhari full knowledge. I go visit am on one Friday and tell am my decision to comot, because I dey always involve and consult am for all my matters.”
Wen dem ask am whether e get political godfather, El-Rufai say, “I get people wey I dey consult before I do anything. I dey always inform dem before I make decision, and if dem tell me make I hold on, I go obey. My first godfather na Muhammadu Buhari. As for di rest, I no go mention dem because if I do, people go begin disturb dem.”
As e dey talk further, di former governor say e no regret say e support President Bola Tinubu for di 2023 election, but e surprise for some of di tins wey dey happen.
E say, “I never regret am, but some tins surprise me. But di reason why I no fit regret be say, some Yoruba leaders from South West come Kaduna come tell me say dem Muslim brothers for di region dey suffer political marginalization. Na di first reason why I support Tinubu.
“Di second reason be say, we don already agree say di 2023 presidential seat go go di South, for fairness, balance, and justice for Nigeria.”
El-Rufai talk say di reason wey make am comot for APC na because di party don forget di principles wey dem take form am.
“APC don leave di reason wey make dem form di party. E don abandon di people. Now everybody just dey find dia own personal gain and how to make money. Government don turn to business wey everything get price.
“No justice dey. People wey work for di party, dem no even recognize dem, talk less of reward dem. Now, appointments na only some people from Lagos dey control am. Di party don die.
“Na why I consult people like Tunde Bakare, Buhari, Abdullahi Adamu, Adams Oshiomhole, and Bisi Akande before I make my decision,” e talk.