Di Inspector-General of Police, KAYODE EGBETOKUN, don order make dem quickly find di people wey cause di explosion for Nganzai Divisional Police Headquarters for Borno State.
Di attack happen yesterday and e lead to di death of two police officers – Inspector BARTHOLOMEW KALAWA and Corporal MUSTAPHA HUZAIFAT.
Di statement wey di Command Spokesperson, NAHUM DASO, release tok say Boko Haram terrorists be di people wey carry out di attack.
According to di statement, di IGP talk say no person or group wey dey involved for di killing of di police officers go escape punishment.