Di Independent National Electoral Commission no gree sabi Julius Abure na di National Chairmo of di Labour Party.
INEC declare im position for inside counter affidavit wey im fill to respond to case by Julius Abure-led National Working Committee of LP for di Federal High Court for Abuja.
Abure want make di court by force INEC to recognize am as di original National Chairman of Labour Party, but INEC dey maintain sey him tenure don expire for June 2024.