Di Independent National Electoral Commission (INEC) don reject di petition wey wan recall Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey dey represent Kogi Central, say e no meet di requirement.
For short statement wey dem drop on Thursday, INEC tok say di petition no meet wetin di constitution talk.
“Di petition to recall di Senator wey dey represent Kogi Central Senatorial District no meet di requirement of Section 69(a) of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria 1999 (as amended),” na wetin INEC write for dia X handle.
For di updated statement, INEC explain say di law talk say make more than half of di registered voters for di constituency sign di petition before dem fit process am.
“Di total number of registered voters for Kogi Central Senatorial District na 474,554. More than half of dis number (wey be 50% + 1) na 237,277 + 1, wey mean say dem need at least 237,278 voters,” INEC National Commissioner and Chairman, Information & Voter Education Committee, Sam Olumekun tok.
“But across di 902 polling units for 57 registration areas and five local government areas wey dey di senatorial district, INEC check di submission wey di petitioners bring and see say na 208,132 signatures/thumbprints dem gather.”
Senator Natasha bin dey suspended for Senate sake of say she no follow di rules, wey make some of her constituents wan recall her. Dem talk say dem no wan make di constituency lack representation as she no fit perform her duties.
Di senator don dey trend for recent times after she accuse Senate President Godswill Akpabio of sexual harassment, wey Akpabio don deny. After di accusation, di Senate suspend her for breaking dia conduct rules.
On Tuesday, Natasha return home to rousing welcome from her people, despite say Kogi State Government don ban rallies and public gatherings. As she address di crowd wey gather for Okehi Local Government Area, she tok say: “Nobody and nothing fit stop me from coming home. I be Ebira woman; dis na my land.”