Justice James Omotosho wey dey Federal High Court for Abuja don order say make Mrs. Favour Kanu, wey be Nnamdi Kanu in sister-in-law, comot for court.
The judge talk say dem no go allow her attend court again for the next three sittings because she record wetin dey happen for court and post am for her social media.
Even though the judge fit don hold her for contempt of court, na because Kanu Agabi, wey be defence lawyer, beg am na im make he no take that action.
Before the judge give him final order, he call Favour come front, ask her why she do wetin she do.
She talk say na live she dey stream wetin dey happen for court, but she no know say judge still dey sit. She come beg and promise say she no go do am again.