Nigerian singer and dancer, Korra Obidi, don stir talk say she dey in relationship with Canadian superstar Drake papa, Dennis Graham.
Di US-based singer give hint say romance dey between dem as she call herself Drake step mama when she post pictures of her and di rapper papa dey hang out for Instagram recently.
As she share di romantic pictures — including one wey show Graham dey kiss her for cheek — Obidi write for caption:
“Korra, Iya Drizzy [Drake mama]. Amazing time with @therealdeniseg.”
She even post one video wey show Mr Graham hold her waist well well, and she caption am:
“Abeg, anything wrong dey for di way he hold my waist? Some people don begin sweat.”
Dennis Graham and him ex-wife, Sandra, bin separate when Drake na just five years old. Even though dem get their wahala before, Drake parents don dey relate better now, as Dennis even celebrate him ex-wife on her 75th birthday.
Korra Obidi sef don divorce, and she get two pikin. She talk say na her mental health make her comot for di marriage. Her ex-husband, Justin Dean, accuse her say she cheat.