Kanye West talk say Jay-Z wan kill am

Kanye West don talk say Jay-Z wan kill am after e drop some kind disturbing talk for social media about Roc Nation boss and Beyoncé pikin dem.

For one post wey e put for X on Wednesday, Kanye talk say Beyoncé use IVF take born her and Jay-Z twin pikin dem, Rumi and Sir, wey be 7 years old.

Later, e come talk say e don delete the post, say na Jay-Z make am do am.

For another set of tweets, Kanye yan say Jay-Z dey plan to assassinate am.

E write:
“I sabi say Jay-Z go dey drive round dey think say, damn, I gats kill Kanye.”

“I sabi say e go pain Jay-Z to kill me, but person gats do am.”

“Plus, I no want make Jews collect credit for my murder.”

 

 

 

 

Posted in Entertainment, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *