Kebbi State Govt Deny Say Bandits Dey Control Villages

De Kebbi State Government don deny de claim say bandits don take over some villages for de state.

 

De Deputy Governor, Senator UMAR ABUBAKAR TAFIDA, tok say dis claim of bandits control of villages for de state na just ordinary imagination from online news sources.

 

Senator TAFIDA tok on top de matter with journalists dem for de state capital, Birnin Kebbi. Him say de Kebbi State Government don tight security across de different communities to prevent any attack by criminal gangs.

 

TAFIDA still explain say one time wey bandits attack and kill seventeen people for Mera village, for Augie Local Government Area, de youth dem for de area face de criminal gang dem,  pursue them comot for the area.

Posted in Crimes, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *