Veteran Nigerian singer, Konga, don come out drag Grammy award-winning artist, Burna Boy, say e use e lyrics and rhythm for some songs without give am credit.
For video wey Konga post for e TikTok page, e talk say Burna Boy mention e name for Sungba Remix with Asake and even use some of e lines and rhythm for di song Update.
But instead make e carry di matter go legal side, Konga dey request collabo as compensation. E talk say make Burna Boy feature for di remix of e track Kabakaba wey go also get Tiwa Savage.
“I dey call out Burna Boy because I notice say e reference me for Sungba Remix and e still use some of my lines and rhythm for Update,” Konga talk.
E still hail Burna Boy say e sabi e style: “I like di fact say you dey feel my vibe, and I appreciate am. But as way forward, I want make you and Tiwa Savage jump on Kabakaba Remix. I dey call you out with respect, and I dey wait your response.”
Now, na to see whether Burna Boy go respond or accept di collabo request.