Liverpool Anfield Title Win Na One Of My Best Days – Slot

Liverpool Anfield Title Win Na One Of My Best Days – Slot

Liverpool manager Arne Slot don talk say di day wey dem win di Premier League title for Anfield na one of di best days for him life, as e begin look ahead to next season.

Di Reds knack Tottenham 5-1 on Sunday take seal their 20th English league title, even with four matches still remain. Di atmosphere for Anfield dat day hot well well as fans full everywhere dey celebrate.

Slot talk say, “E fit be one of di best days for many Liverpool fans — and I go talk say na di same for me too. Di way everything go dat day — from when we land stadium, see how fans don dey ginger already, even before match start.”

He continue: “When we first go 1-0 down, e be like say, ‘Dem no go give us this title easy, we go gats work for am.’ But as we come score, I see wetin e mean to di players and to di fans. E really special to be part of dat kind moment.”

Liverpool go still play Chelsea, Arsenal, Brighton and Crystal Palace before di season end. Slot talk say di tough matches go help prepare dem for next season.

He say: “E good say we go play strong teams like Chelsea, Arsenal, Brighton and Palace. Even though na end of season, we fit still use am start to prepare for next season.”

Di Dutch coach still express surprise say dem dey 22 points ahead of Chelsea, especially as he believe say Chelsea bin play better pass dem when dem meet last October — even though Liverpool win 2-1.

He say: “For dat match, we suffer pass any other match this season. But to still end up many points ahead of dem na big kudos to everybody for this club.”

Slot talk say he go rotate di squad for di final matches of the season: “Some players deserve to don play since because dem dey train well, dem good enough. Now na time to give dem chance, also to test dem for next season.”

On recruitment, Slot say winning di league go attract better players: “Winning league, with di kind fans wey we get, e go make any player wan join us.”

He confirm say Virgil van Dijk and Mohamed Salah don sign new contract, but no update yet on Trent Alexander-Arnold, wey people dey talk say Real Madrid dey eye for summer.

 

Posted in Sports, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *