LP Crisis: JULIUS ABURE drag INEC go court to reject Caretaker Committee of NENADI USMAN

Di National Working Committee of the Labour Party wey Julius Abure dey lead don drag di Independent National Electoral Commission go court.

 

Abure with him NWC members want make di Federal High Court for Abuja stop INEC to recognise di caretaker committee wey sentor Nenadi Usman led.

 

Remember se Nenadi Usman emergence as leader of di caretaker committee na afta the wahala wey follow di National Executive Council meeting wey dey hold for Umuahia, Abia State.

 

Na di National Publicity Secretary of the party, Obiora Ifoh naim confam di court move and him tok se dem no dey directly target di caretaker committee as e bi se di NWC no even sabi that body.

Posted in Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *