Suspended Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don mark two years for office with one touching message to di people of di state, where e thank dem for dia strong support and still promise say im go continue to dey pursue peace, reconciliation, and government wey go carry everybody along.
For di statement wey mark di anniversary of im swearing-in on May 29, 2023, Fubara talk say di moment na time to think well and renew im strength.
Fubara talk say di support wey di people give am na wetin give am boldness to continue to dey find unity and healing even as political wahala still dey ground.
“Una support don give me liver to push forward, no retreat, but to work harder to bring peace, reconciliation, and forgiveness,” e talk.
“All dis na important if we wan bring back normal life and deliver better roads, programmes wey go touch people life, and services wey go make sense for all corners of di state.”
As e recognize say political katakata don plenty since e enter office, Fubara still talk say even though progress slow small, im administration still dey serious with wetin dem promise di people.
E mention better improvement for health sector, education, road and building works, youths and women matter, say all dis na proof say im dey try small small.
“Even with all di gbas gbos, I never shake or lose focus. Na di oath wey I take and promise wey I make to always put Rivers State first still dey guide me,” na so di suspended govnor yan.
E still assure di people say im stand gidigba and nothing don change am.
Fubara praise Rivers people for dia patience and how dem don help to hold di vision of unity and progress, and im promise to put more effort to build peace, security, and better life for everybody.
Im also use di opportunity beg politicians and people wey still vex make dem forget di past wahala and join body make Rivers State strong again.
“To anybody wey still dey carry di burden of all di political wahala wey don happen, I dey beg — make we turn new page, join hand, and focus on wetin go carry all of us forward. Na now we suppose begin rebuild and rise,” na so im beg dem.
Di governor end with better hope say all di decisions wey im government go dey take from now go always dey for di good of di people and for long-term betterment of Rivers State.