Mistake Fit Happen – Amorim Still Support Onana After That Lyon Wahala

Mistake Fit Happen – Amorim Still Support Onana After That Lyon Wahala

Manchester United keeper Andre Onana commit two costly errors as dem draw 2-2 with Lyon for Europa League quarter-final first leg.

Before di match, Lyon player Matic blast Onana, call am “one of di worst” in United history. Fans even dey boo am any time e touch ball.

Onana no fit stop Almada free-kick, and later another mistake from am give Cherki equaliser with di last kick of di game.

United coach Ruben Amorim defend am:
“Mistake fit happen, na football. I no get anything wey I go talk now wey go help am. We go focus on di second leg.”

United still never lose for Europe this season, but dat late goal make di players feel down.

Amorim say:
“We draw away, no be small thing. But we suffer small. We gats turn things around.”

Yoro, wey score him first goal for United, believe dem go finish work for Old Trafford.
Cherki, wey score Lyon last goal, warn United say:
“We see fear for una body from beginning. Una dey shake. Second leg? We dey come win am.”

Posted in Sports, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *