Mokwa Flood: Tinubu Don Approve ₦2 Billion Plus 20 Trailer Rice for Victims

Mokwa Flood: Tinubu Don Approve ₦2 Billion Plus 20 Trailer Rice for Victims

President Bola Tinubu don approve make dem release ₦2 billion sharp sharp to rebuild all di houses wey flood damage for Mokwa, Niger State.

Na Vice President Kashim Shettima talk dis one when im visit Mokwa after di serious flood wey kill plenty people, scatter properties, and make hundreds people lose their homes.

Shettima still talk say President Tinubu don also approve make dem carry 20 trailers of rice go give di victims as emergency help.

E talk say President Tinubu heart dey with di people and say all di wahala wey dey disturb dem go soon get solution.

Di VP also talk say di President don order make dem repair di broken bridges for di area without delay.

On top drainage matter, Shettima say President don still give instruction make dem fix di gutter and water way dem for inside Mokwa town.

Di flood wey happen for May 28, 2025, don already claim over 200 lives for different communities inside Mokwa.

Di Commissioner for Humanitarian Affairs for Niger State, Ahmad Suleiman, talk say dem still dey find more dead bodies.

“We don recover more than 200 bodies but we still dey search. Till now, we never fit talk exactly how many people die because we never recover all di bodies,” na wetin Suleiman yarn for interview.

E talk say di state government don already start emergency response to distribute relief materials give people wey flood pursue from their house wey now dey stay for temporary camps.

“Niger State Government don put some things in place and different agencies and ministries don join hand. But di damage wey dis flood cause, you no go understand unless you go there with your eye see am. Na real serious matter be dis.

“Di state government don send rice trailer go meet di victims. Even di governor wife come Mokwa yesterday, she come give dem ₦50 million,” Suleiman add.

But as all these dey happen, some of di victims wey flood pursue from their house dey complain say dem no dey enjoy di relief help well.

Many of dem dey talk say di camp wey government provide no good at all, and dem no even dey see food or supplies like dem suppose get.

One of di victims, Mama Isah, talk say: “We be 17 people for my house, but dem give us only one loaf of bread and small tea. How dat one go reach even for breakfast?”

Posted in Metro, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *