Di National Agency for Food and Drugs Administration and Control don close down one factory for Trade Fair Complex for di Lagos Badagry Expressway sake of se dem dey produce fake cosmetic products.
NAFDAC operatives, wey go burst the illegal factory for Benue Plaza for Trade Fair Complex discover plenti chemicals and packaging materials wey dem no register plus expired products wey dem dey change di date to resell.
NAFDAC for their x.com handle report se em operatives seize I,200 cartons of fakes comestic products wey di value na fifty million naira.