Popular Nigerian comedian wey don turn singer, Nasboi, don start 36-day kneeling tour across di whole country.
Di singer talk say di tour na campaign to beg Davido make e give am verse for song, after many times wey e don try reach am no work. Di tour start on Wednesday.
Nasboi explain say e don dey mimic Davido for five years now just to get him attention for music matter.
As e announce di tour for Instagram, Nasboi post one picture where e hold placard for front of Osun State Government Secretariat.
By Thursday, dem see am for Kano State Government House where e dey kneel down.
For caption, Nasboi write: “I go dey kneel down for all 36 states for 36 days. I dey pray make this dream come true. Abeg make una tag @davido anytime wey una see di post.”