Di Court of Appeal wey dey Abuja don throway two motions wey Senate President, Godswill Akpabio, file, and dem still fine am ₦100,000.
Na Justice Hamman Barka lead di three judges wey sit for di matter on May 21, 2025, and dem strike out di motions afta Akpabio beg say make dem withdraw di appeal.
Dem get certified true copy of di ruling by Tuesday night.
Di motions, wey dem file on March 3 and March 25, 2025, with case number CV/395/M1/2025 and CV/395/M2/2025, get Akpabio as di person wey carry di mata go court (Appellant).
Senator Natasha Akpoti-Uduaghan, Clerk of di National Assembly, di Senate, and Senate Committee Chairman on Ethics, Privileges and Public Petitions, Senator Neda Imasuem, be di people wey dem carry di case against (Respondents).
For di appeal, Akpabio dey find court order to:
- Allow am extra time to take beg appeal against di Federal High Court judgement for Suit No: FHC/ABJ/CS/384/2025 wey dem give on March 10, 2025, for di case wey Senator Natasha carry go court.
- Grant am permission to appeal based on wetin e talk say na matter of both law and facts.
- Allow am file notice of appeal late.
- Make court stop further hearing of di case for di lower court until Court of Appeal finish di matter.
But for di ruling, di Appeal Court talk say:
“Di application to withdraw di two motions wey dem file on 20/3/2025 and 25/3/2025 don succeed, and di motions don officially strike out.
“We award ₦100,000 costs to di first respondent. Case number CA/ABJ/PRE/ROA/CV/395M/2025 make dem delete am.”