Nigeria Dey Celebrate June 12 As Governors Beg Nigerians Make Dem Uphold Democratic Values

Nigeria Dey Celebrate June 12 As Governors Beg Nigerians Make Dem Uphold Democratic Values

E don reach 26 years since democracy come back for Nigeria. For these years, di kontri don see five presidents and plenti elections wey bring new leaders for both national and state level.

Before-before, Nigeria dey celebrate Democracy Day for May 29 – di same day wey former President Olusegun Obasanjo take do swearing-in for 1999. But for 2018, former President Muhammadu Buhari change am to June 12 to honour di June 12, 1993 election wey many people believe na di freest and fairest for Nigeria history.

To take mark Democracy Day this year, President Bola Tinubu go talk to Nigerians for joint session of di National Assembly. Plenti other activities dey happen for Abuja and other parts of di kontri to celebrate di day. But unlike before, dem no go do di normal ceremonial parade for Abuja.

Di Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar, talk say dis year celebration na example of how democracy suppose be for West Africa. For one statement wey him special assistant, Alkasim Abdulkadir sign, Tuggar talk say Nigeria democracy don turn model for others to copy as political wahala dey increase for di sub-region.

“Democracy no be only our internal matter. E be our way of contributing to peace for di region. As we dey progress, e dey strengthen democracy for Africa as a whole,” him talk.

Governors too don use the opportunity beg Nigerians make dem stand gidigba for democracy and reason well on how far di kontri don go.

Niger State Governor, Umaru Bago, talk say this year Democracy Day mean say di people power don win over dictatorship. E remind everybody say people wey fight for Nigeria democracy suffer, get hope and no give up.

For statement wey him Chief Press Secretary, Bologi Ibrahim release, Bago talk say democracy don bring transparency, accountability, strong political competition, freedom to talk, and better engagement from citizens.

Edo State Governor, Monday Okpebholo, talk say make Nigerians reason the strong lesson wey June 12 teach and renew dem commitment to democracy, justice, and unity.

“As we dey celebrate June 12, our Democracy Day, make we remember how Nigerians come together that day for 1993 to speak with one voice,” Okpebholo talk.

“Na time to honour M.K.O. Abiola and others wey fight for di democracy we dey enjoy today,” he add.

Kaduna State Governor, Uba Sani, join voice with Edo and Niger governors. He beg both leaders and citizens make dem use this day take renew their mind to protect democracy and work together for better future.

“June 12 hold special place for Nigeria history. Na big turning point for our struggle for democracy and our waka to build better, free and just kontri,” he talk.

Di suspended Governor of Rivers State, Siminalayi Fubara, still talk say him go continue to support inclusive democratic system wey go carry everybody along, no matter your political side.

He talk say Rivers State don pass through both better and hard times for their democratic journey, but all na to show say make dem continue to stand firm.

But even as people dey celebrate, some states dey plan protest. Organisers like Take It Back Movement don talk say democracy dey under threat.

Dem say di protest go happen for National Assembly, where President Tinubu go talk to di nation. According to dem, protest go shele for Abuja and 19 other states.

For Lagos, security don strong as police don full ground. Some youths too don dey gather for Akure, wey be Ondo State capital, for their own protest.

Posted in News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *