Minister for Foreign Affairs, YUSUF TUGGAR tok say Nigeria don start to put into action di memoranda of understanding (MoUs) wey Nigeria and China bin sign.
De Report tok say dem sign some memoranda when President BOLA TINUBU bin visit china to meet with di Chinese President XI JINPING for September 2024.
TUGGAR tok for one statement say him and di chinese foreign minister WANG YI, bin confirm say di MoUs don dey for different stages for action. dis one include cooperation for peaceful use of nuclear energy
E talk say di signing don raise Nigeria-China relationship to understanding strategic partnership.
Di minister also talk say Nigeria go continue to support China, and e praise di fact say both countries no get tension between dem.