No dey compare me with una faves just to find clout – Timini Egbuson

Timini Egbuson don warn people make dem no dey compare am with dia faves just to find clout.

Di Nollywood actor talk say e don notice how promoters and fans dey always put hin name inside social media talk just to promote dia faves and clients.

Egbuson yarn say e no need all dat, as e get hin own fanbase wey don support am for di past 15 years.

For hin X handle, e write: “I fit smell PR campaign from far, and to be honest, e don dey boring. Push your fave in peace, no dey involve my name. I don find my people, and dem love my work. 15 years strong.”

Posted in Entertainment, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *