‘No More War!’: Pope Leo XIV Beg Nigerians Make Dem Embrace Peace For Him First Sunday Talk

‘No More War!’: Pope Leo XIV Beg Nigerians Make Dem Embrace Peace For Him First Sunday Talk

Pope Leo XIV don beg make war end for di world as e hail people wey gather for St Peter’s Basilica on Sunday. Dis na him second public appearance since e become di new head of di Catholic Church.

“My brothers and sisters, happy Sunday!” na so di first American pope from Chicago take greet di tens of thousands wey full St Peter’s Square. Di crowd shout, clap and wave flags with joy.

After im prayer to Virgin Mary, di pope no fear talk about wetin dey happen for di world. E remember say last week na 80 years since World War II end, war wey kill 60 million people.

“For this kain serious situation wey we dey now — wey Pope Francis bin always talk say na like third world war in small-small pieces — I still dey beg world leaders: No more war!” Pope Leo talk from di balcony.

Posted in News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *