NPFL: Enyimba Gats Step Up If Dem Wan Qualify for Continental Football

Enyimba Coach Eguma Still Get Hope Say Dem Go Qualify for Continental Football

Enyimba technical adviser, Stanley Eguma, don talk say e still believe say hin team fit secure continental qualification before season go end.

The People’s Elephant don extend their unbeaten run to four matches after dem play 2-2 draw against Ikorodu City on Sunday.

Eguma yarn say e important make hin players ready for the tough matches wey dey come.

“We dey take am one game at a time,” Eguma tell Complete Sports.

“After we manage draw for Lagos, we gats go house go put in extra effort for our home games. No match easy, every game na challenge.”

“We gats plan well for each match till season end. We still dey hope say we go qualify for continental, but e go need plenty hard work. We still dey on track.”

Posted in Sports, Trending.