Obasa land for Lagos Assembly

Obasa land for Lagos Assembly

Former Speaker of di Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, don storm di assembly complex.

Tori wey reach us talk say Obasa enter di Speaker’s office around 12 noon on Thursday, follow by some security officials.

Di matter happen after dem withdraw di security aides wey dey guard Speaker Mojisola Meranda.

Di Chief Press Secretary to Meranda, Segun Ajiboye, confirm di latest update for short message on Thursday, accuse Obasa and im people say dem force enter di office.

“We dey assembly now,” one person from Obasa camp also talk.

Read Also:Lagos Assembly wahala: Dem withdraw Speaker Meranda security aides

Posted in Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *