Ondo Election: IGP Say No Work for Amotekun for Election Day

Di Inspector General of Police, KAYODE EGBETOKUN, don order di Western Nigeria Security Network – Operation Amotekun – make dem comot hand for di governorship election for Ondo State on Saturday, November 16, 2024.

Di Force Public Relations Officer, OLUMUYIWA ADEJOBI, na him confirm di IGP order, just as him also confirm say di Nigeria Police Force don position him men for election security duty for Ondo.

 

ADEJOBI tok say IGP EGBETOKUN also order di Air Wing of di Nigeria Police Force to carry out aerial patrols with police helicopters, while di Marine Police Wing go do gunboat patrols along rivers and creeks for Ondo State.

 

The Force tok-tok person say na only di federal security agencies and other members of the Inter-Agency Consultative Committee on Election Security them go allow for security work for di Ondo State election.

Posted in News, Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *