Ondo PDP Dey Demand Replacement of REC Toyin Babalola Before Nov 16 Governorship Election

Di People’s Democratic Party, PDP, for Ondo State still dey demand for the replacement of di Resident Electoral Commissioner wey be Toyin Babalola.

 

Tok-tok person for di PDP Governorship compaign wey be AYO FADAKA tok say REC BABALOLA don live for ONDO state for long time and him don too dey mix with di politicians for there.

 

FADAKA also dey question the plan of the All Progress Congress, APC, wey dey defend REC BABALOLA, just as him dey fault the objection of di Inter-Party Advisory Council, IPAC.

 

But the Labour Party governorship candidate for Ondo State wey be AYODELE OLORUNFEMI talk say di main reason for di PDP demand for the removal of di Resident Electoral Commission no hold ground.

Posted in News, Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *