Catholic Archdiocese of Owerri don confirm say dem kidnap one of dia priest, Reverend Father John Ubaechu, wey be parish priest for Holy Family Catholic Church inside Izombe, Oguta Local Government Area of Imo State.
For one statement wey Archdiocese Secretary, Reverend Father Patrick Mbarah, sign, dem talk say dem kidnap di priest on Sunday, March 23, 2025, for Ejemekwuru road inside di local government area as e dey go di Priests’ Annual Retreat.
Di Archdiocese don beg all Christian faithful and people wey get good heart make dem pray well-well for di quick and safe release of di priest.
Meanwhile, Imo State Police Command tok say di Commissioner of Police, Danjuma Aboki, don start investigation on di matter and don order intelligence-led operation wey go help rescue di priest without any condition.
Di police still beg di public make dem give any better information wey fit help dem secure di release of di kidnapped priest.