Di Oxford English Dictionary don add 20 Nigerian words and expressions to their latest update.
Di new words wey dem add include popular slangs like “japa,” “agbero,” “eba,” “419,” and “abi,” among others.
Dem tok say this words, wey dey part of di everyday life of Nigerians, show say Pidgin English, street slang, and cultural expressions dey get global recognition.
Dem tok again say, some of di words, like “japa” and “jand,” don appear as both nouns and verbs for di dictionary.