Oyo State Government don charge ex-queen of Ooni of Ife, Naomi Silekunola,and di owner of Ibadan-based radio station, Oriyomi Hamzat, Principal of Islamic High School, Bashorun, Ibadan, Abdulahi Fasasi, for manslaughter and murder for di funfair rush rush wey kill 35 children for inside ibadan on di 18th of December.
Di government tok say their offences bin go against Section 324 of di criminal Code, CAP 38,Vol II, Laws of Oyo state, sake of say di organizers dem no provide enough security, crowd control, and medical facilities to prevent di rush rush wey happen during di children funfair wey dem organise.
Di names of di children wey die include Musiliu Sofiat, female, eight years; Lekan Salami, male, seven years; Feyikemi Salam, female, 1.5 years; Olaniyan Joshua, male, 1.5 years; Laeef Muisi, male, eight years; Opeyemi Ayomide, female, four years; Adebayo-Fatimah, female, four years; Adebayo-Abibat, female, five years; Adeyanju Taiwo, female, eight years; Salaudeen Khalid, male, minor; Anjorin Faridat, female, 10 years; Nahaam Muisi, male, 13 years; and Babatunde Toheeb, male, 18 years.
Governor Seyi Makinde tok say di state don vow to prosecute di organizers dem according to di law, e also tok say di defendants dem don dey custody since December 24 wey di police arrest dem.