Passengers don stranded as container wey fall block road for Lagos-Ibadan expressway

Passengers don stranded as container wey fall block road for Lagos-Ibadan expressway

Passengers wey dey comot for Lagos, Nigeria economic headquarters, don stranded on Thursday afternoon as two container fall block the busy Lagos-Ibadan Expressway.

The first accident happen around 10:50 am for the popular Kara Bridge, while the second one shelle for 2 pm on top Long Bridge, both for Lagos-Ibadan Expressway.

E be like say hundreds of motor don jam for the traffic wey the accident cause. As at when dem dey write this report, the go-slow don reach Otedola Bridge and even extend go back near Alapere area.

Federal Road Safety Corps (FRSC) spokesperson for Ogun State, Florence Okpe, tell Channels Television say FRSC officers and other emergency teams don start work to clear the road.

She still talk say nobody wound or die for the accident, and first responders dey on ground to make sure say traffic laws dey followed and movement fit resume small small.

 

Posted in Metro, Trending.