PDP, APC Dey Quarrel Over Ondo State Governorship Election Result

De All Progressives Congress dey celebrate de victory of Governor LUCKY AIYEDATIWA for Ondo State governorship election.

De APC sef dey praise de Independent National Electoral Commission and security agencies them for their roles to make sure say de election bin dey successful.

De Returning Officer for de election, Professor OLAYEMI AKINWUMI, declare Governor AIYEDATIWA winner of the election for de collation center on Sunday in inside de state capital, Akure.

Professor AKINWUMI, wey be Vice-Chancellor of de Federal University, Lokoja, Kogi State, tok say Governor AIYEDATIWA score three hundred and sixty-six thousand, seven hundred and eighty-one votes to win the election.

APC National Publicity Secretary, FELIX MORKA, tok say de victory of Governor AIYEDATIWA show say de people of Ondo State don accept im administration policies and programmes, plus de Campaign message of hope and consolidation.

But de People’s Democratic Party don condemn de conduct of the Ondo State governorship election by INEC.

De PDP candidate and former deputy governor, AJAYI AGBOOLA, score one hundred and seventeen thousand, eight hundred and forty-five votes to finish second.

National Publicity Secretary of PDP, DEBO OLOGUNAGBA, tok say de party right now dey review results of de election to determine their next line of action.

Inside one statement wey him release on Sunday, OLOGUNAGBA tok say PDP consider de Ondo State election on Saturday as de worst for de history of all elections by INEC.

PDP tok-tok person allege say plenty vote buying bin happen for Ondo on Saturday, Him say that one bin dey possible because of de massive poverty wey dey among de people.

Posted in News, Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *