Rivers state activist, Jake Epelle, don talk say any plan wey former governor Nyesom Wike and im loyalists for state House of Assembly get to impeach Governor Siminalayi Fubara no go succeed.
Epelle yarn say Wike no fit dey talk about peace and at the same time dey push im people for Martins Amaewhule-led Assembly to remove Fubara.
“Make dem try impeachment, dem no go succeed,” Epelle talk for one programme wey dem monitor.
“Nobody go impeach Fubara. I dey talk am openly for national TV because im never commit any offence wey deserve impeachment. Rivers people dey solidly behind am.
“If dem impeach am, wetin go happen? Nothing. Rivers people no be wahala people as dem dey paint us, but we go stand gidigba for Fubara and for democracy.
“This wahala wey dem dey cause suppose stop because e fit happen to another person tomorrow. Make dem stop to dey use impeachment as threat.”
Di kasala between Wike-backed Assembly and Fubara still dey hot as dem no gree allow di governor enter Assembly Quarters on Wednesday to re-present di 2025 state budget, as Supreme Court rule on February 28, 2025.
Fubara talk say e don already inform Amaewhule about im visit, but di Assembly claim say dem no receive any official message.
Meanwhile, Wike, wey be Minister of Federal Capital Territory, yarn for media parley for Abuja say nothing dey wrong if lawmakers decide to sack Fubara for allegedly holding their salary for months.
Epelle criticize di Assembly say dem disgrace di governor and dem no dey ready for peace. E also blast Wike say im dey add fire for di matter with im impeachment talk.
“Wike no get constitutional power to remove governor. E fit call for impeachment but e no be Assembly member,” Epelle talk.
“E get pipo wey dey beat drum for di masquerade wey dey dance. I hear say as governor dey reach di gate, dem receive call from Abuja wey tell dem make dem no see di governor.
“So e be like say some pipo dey somewhere dey control di Assembly members like puppets. E no good at all,” Epelle add.