Operatives of di Nigeria Police Force don burst a gang of cybercriminals, and dem arrest 130 wey dem allege se involve for hacking and threat to national security.
Force Public Relations Officer, Olumuyiwa Adejobi tok for statement se di suspects reach 17 Nigerians and 113 foreigners.
Adejobi tok se di dem arrest di suspects during di time wy dem raid Next Cash and Carry area for Jabi, Abuja wey dem allege se dem dey use computers and other sophisticated devices to facilitate criminal activities.
Di Force tok tok person tok se na di Assistant Inspector General of Police for zone 7 Headquarters for Abuja, AIG Benneth Igweh led di operation on Saturday November 3, 2024.