President Tinubu Don Enter Saudi Arabia for Joint Arab-Islamic Summit on Middle East Crisis

President BOLA AHMED TINUBU don travel go Saudi Arabia for di Joint Arab-Islamic Summit, wey begin this Monday, November 11, 2024.

 

President TINUBU enter di capital, Riyadh on Sunday, and di Deputy Governor of Riyadh, Prince MOHAMMED BIN ABDULRAHMAN BIN ABDULAZIZ, bin dey for ground to welcome am.

Presidential tok-tok person, BAYO ONANUGA, say na King SALMAN and Crown Prince Mohammed BIN SALMAN invite President TINUBU to attend the summit.

 

ONANUGA say di summit go focus on di crisis situation Middle East, and President TINUBU go present Nigeria’s position on for di Israel-Palestinian conflict, wey him go call immediate ceasefire and peaceful resolution.

Posted in News, Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *