President Tinubu Don Order Make Dem Hunt People Wey Kill Edo Alleged Kidnappers

President Tinubu Don Order Make Dem Hunt People Wey Kill Edo Alleged Kidnappers

President Tinubu Don Order Make Dem Hunt People Wey Kill Travellers Wey Vigilante Mistake For Kidnappers

President Bola Tinubu don vex say some travelling hunters wey people mistake for kidnappers don die for Uromi community inside Esan North Local Government Area for Edo State.

For statement wey Special Adviser to the President (Information and Strategy), Bayo Onanuga, drop on Friday, e talk say Tinubu shock as e hear the bad news on Thursday. E don tell police and other security people make dem do quick and serious investigation, come make sure say dem punish who do am.

“President Tinubu dey feel for di families of di people wey die, and e assure dem say e no go allow criminals dey waste innocent Nigerians,” di statement talk. E still talk say make people no dey use jungle justice, say Nigeria no be place for dat kain tin.

Tinubu yarn say every Nigerian get right to waka anywhere for di country. E still hail Edo State governor, Senator Monday Okpebholo, plus di community leaders for Uromi, as dem quick show face make problem no worse.

Police for Edo don already arrest 14 people because of di wahala. Dem talk say di people wey die na hunters, but some community people suspect dem say dem be criminals, come mob dem.

Edo State Police Command tok say na 16 people dem kill. Di Police spokesperson, Moses Yamu, talk say dem don arrest some people wey fit sabi di matter.

“As we dey investigate di matter, we don hold 14 suspects. We still do emergency meeting with community leaders and other people to find solution,” Yamu tok on Friday.

Police explain how di incident take happen. Dem talk say di wahala start when one truck wey get registration number KKF 225 XA, wey dey come from Port Harcourt and carry 25 travellers from Elele inside Rivers State, jam one vigilante group for Uromi. As dem search di travellers, dem see some hunters wey carry locally made dane guns, na im dem arrest dem.

“As dem dey hold di travellers, some vigilante members shout say dem be kidnappers. Na so mob from di community come attack dem, lynch 16 of di people wey dey inside di truck, come burn di truck join,” police tok.

“Police from Uromi Division rush come di scene, dem fit rescue 10 travellers, two of dem wound well well, dem rush dem go hospital and dem don dey recover.”

Police don send special Mobile Force team and other security people go di area to make sure say another fight no start. Dem still dey investigate di matter and don warn people make dem no do any revenge attack.

Meanwhile, di Northern Senators Forum don vex well well as dem hear say di travellers wey dem kill na people wey dem just accuse say dem be Fulani kidnappers.

For statement wey Chairman Sen. Abdulaziz Yar’Adua sign, di senators tok say dem dey sad say innocent Nigerians just die like dat.

“Northern Senators Forum dey deeply disturbed and e pain us say some mob just kill innocent Nigerians like dat for Uromi, Edo State, on Thursday, 27th March 2025.

“Di people dey travel go north, but because some people think say dem be Fulani kidnappers, dem come kill dem anyhow.”

Di senators condemn di act, say na serious human rights violation. Dem call Edo State government make dem take action fast fast on top di matter.

Posted in Metro, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *