Real Madrid Don Gree To Sign Alexander-Arnold

Real Madrid Don Gree To Sign Alexander-Arnold

Trent Alexander-Arnold go become Real Madrid player on Sunday, 1st of June, after Liverpool gree make e comot early from im contract as dem don collect transfer fee.

Dis move mean say di England right-back go fit join di Spanish team in time to play for di Club World Cup.

Alexander-Arnold don already talk before say he go comot from Liverpool this summer, and now e don sign six-year deal with Madrid.

Di 26-year-old for fit waka comot for free when im contract expire on 30 June, but now dem don gree early release.

FIFA don allow extra transfer window from 1st to 10th June so teams fit register new players for the extended Club World Cup wey go start 14 June for United States.

Alexander-Arnold don dey Liverpool since e be pikin of six years when e join di club.

E don win two Premier League titles, Champions League, FIFA Club World Cup, UEFA Super Cup, FA Cup and League Cup with Liverpool.

But earlier this month, e talk say e wan leave to find “new challenge” and test imself “personally and professionally.”

Alexander-Arnold dey leave Liverpool with 23 goals and 86 assists for 352 matches.

E go join England teammate Jude Bellingham for Madrid, and also link up with former Liverpool and Real Madrid midfielder, Xabi Alonso.

Alonso, wey be 43, don take over from Carlo Ancelotti as Real Madrid manager after di club no win any major domestic or European trophy for di first time since 2020-21.

Posted in Sports, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *