Football fans go enjoy better action on Sunday (today) as plenty big matches go take over both English Premier League and Spain LaLiga.
For Premier League, Chelsea go host Leicester City for Stamford Bridge, while Tottenham Hotspur go face Bournemouth, as both matches go start by 15:00 GMT.
Later for evening, all eyes go dey Old Trafford as Manchester United go jam Arsenal for one big clash wey go start by 17:30 GMT.
For LaLiga, Getafe go open the day action by 14:00 GMT as dem go play tough match against Atletico Madrid.
By 16:15 GMT, Real Madrid go try collect important points as dem welcome Rayo Vallecano go Santiago Bernabéu.
The action go continue by 18:30 GMT with two matches wey go happen the same time—Athletic Club go play Mallorca while Real Betis go face Las Palmas.
To close the day, Real Sociedad go battle Sevilla for one late-night fixture wey go start by 21:00 GMT.