Supreme Court Don End Impunity For Rivers, Wike Tok

Supreme Court Don End Impunity For Rivers, Wike Tok

The Supreme Court ruling on di wahala wey dey shele for Rivers State House of Assembly don end impunity for di oil-rich state, na wetin FCT Minister, Nyesom Wike tok on Friday.

Di apex court for dia ruling on Friday, don stop Central Bank of Nigeria (CBN), di Accountant General of di Federation and oda government agencies from releasing money give Rivers State government until dem clear demsef from wetin di court call “open disobedience to court order.”

Di five-man panel of di court join mouth dismiss di cross-appeal wey Governor Siminalayi Fubara file, wey challenge di validity of di House of Assembly wey Martin Amaewhule dey lead as Speaker.

Supreme Court still cancel di recent local government elections wey dem do for di state, say di election no get leg because e no follow Electoral Act.

After di judgment, di minister yarn journalists and praise di judiciary for standing gidigba for rule of law.

“If you allow dis kind thing, one day, na only one member go just form assembly and nothing go fit happen. E no dey happen! We must hail di judiciary for di bold step wey dem take to end dis impunity,” Wike tok.

“You no follow Electoral Act do local government election, yet people dey praise am (Governor Siminalayi Fubara), ‘Yes, you try well well.’”

Wike, wey be former Rivers State Governor, still throw shade give di Chairman of di Peoples Democratic Party (PDP) Governors’ Forum and Bauchi State Governor, Bala Mohammed, for supporting Governor Siminalayi Fubara.

E tok say Rivers State Governor no get choice but to obey di Supreme Court verdict because na di final authority for di mata.

“I hope dem go still hail am today. I hope di PDP Governors’ Forum Chairman go still praise am today. Supreme Court don tok say enough don do, make we no scatter our democracy,” Wike add.

Di FCT Minister tok say di wahala wey don last for over 15 months don finally get conclusion from di highest court for di land, and di only appeal wey remain na to carry di case go meet God.

“People dey call my name up and down—‘Wike Wike.’ No be about me. How pesin go demolish State Assembly building and carry e own small group go him house? E no fit happen!

“For me, dis judgment na joy for Nigerians and Rivers people. Dis impunity must end. We no go allow am happen. We no fit allow anybody spoil di democracy wey we dey enjoy,” Wike yarn.

E still add say di mata no be about hiring 40 Senior Advocates of Nigeria (SAN), but na about making sure say rule of law dey respected and say competent people dey handle di case.

Posted in News, Politics, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *