Tinubu Airport for Minna Don Become Backup for Abuja Airport – Keyamo

Tinubu Airport for Minna Don Become Backup for Abuja Airport – Keyamo

Di Bola Ahmed Tinubu International Airport wey dey Minna don officially become di alternative airport to Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja.

Minister of Aviation, Festus Keyamo, announce this one during di first flight takeoff by Overland Airways from di Tinubu Airport for Minna.

Keyamo talk say di airport get correct look, better runway, fine environment and correct location wey fit match any international airport anywhere for di world.

“Di runway na international level — even Boeing 747 and triple 7 fit land here. Why dem no use am well all these years still be mystery,” e yarn.

E come talk say, “Our eye dey this airport well. As minister wey get di power, I dey declare say Minna Airport go be backup airport to Abuja Airport. NCA, FAAN, make una take note,” na so Keyamo take talk.

Posted in News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *