One federal high court for inside Abuja don order de detention of four suspected terrorists wey dey connected to one notorious bandit kingpin, BELLO TURJI.
De suspects dem na MUSA KAMARAWA, ABUBAKAR HASHIMU and SAMUEL CHINEDU.
De suspects bin face court charges, before de presiding judge, EMEKA NWITE, on eleven-count charge wey dey close to terrorism, na im dey charge against dem by attorney-general of de federation.
De prosecution allege say between 2018 and 2022, de defendants dem, bin conspire to commit acts of terrorism for inside Sokoto state.