BROWN IDEYE Don Make Him Enyimba Debut

Nigeria international, BROWN IDEYE don make him Enyimba debut as late substitute for de goalless draw wey Enyimba play against Bendel Insurance for de  Nigeria Premier Football League.

According to de report, de match na also STANLEY EGUMA’s first game as head coach of de  People’s Elephant.

Dem tok say IDEYE  bin replace IFEANYI IHEMEKWELE for 86th minute, however him  no fit help Enyimba break through.  Adding say De hosts still no fit win for de  last 10 matches wey dem don play for all competitions.

Dem note say, Enyimba move up to ninth for de league table, while Insurance move to 15th. but De two teams go face each other again for de reverse match next month.

 

Posted in News, Sports, Trending.