Borussia Dortmund coach Niko Kovač don admit say him team still get “plenty work to do” even as dem don dey improve, ahead of di Champions League home match against Lille wey go shele on Tuesday.
Last season, Dortmund reach Champions League final, but dis season, dem dey struggle for Bundesliga as dem dey 10th position, and e fit hard dem qualify for European football next season.
Kovač, wey take over after dem sack Nuri Şahin for January, don help make di team balance small. Dortmund win two Bundesliga matches back-to-back for di first time dis season afta dem beat St. Pauli for weekend. Na only di second time wey dem don win away match dis season.
Di former Bayern Munich, Eintracht Frankfurt, and Monaco coach talk say di team dey make progress.
“We don already stabilize small, and we dey work on am every day, whether for training ground or for meeting room,” Kovač yarn for press conference on Monday before di last-16 first leg.
“E good, but we still get plenty room to improve. We never reach di level wey we wan dey, but I like as di boys dey respond.”
Dortmund don lose only one of di last 16 games wey dem play for Westfalenstadion.
“Our stadium be like fortress. E hard to play here—e dey very tricky and challenging,” Kovač tok.
“I hope say we go fit use di atmosphere take put pressure on Lille.”
Lille, wey don win Ligue 1 two times for di last 14 years, never reach Champions League quarter-final before.
Dem be di only French team wey enter top eight for di new Champions League league phase, but dem go enter Tuesday match after dem chop 4-1 defeat from Paris Saint-Germain for Ligue 1.