Unknown Attackers, Don Kidnap One Female Austrian Citizen For Niger Republic.

Unknown Attackers, Don Kidnap One Female Austrian Citizen For Niger Republic.

Di Austrian foreign ministry tok  say, some unknown attackers don carry one of their female citizen for di military-run West African country,  for inside Niger Republic.

Dem confirm di incident to AFP and tok say dem don hear about “possible kidnapping of an Austrian woman” for Agadez.

Di victim, wey dem name EVA GRETZMACHER, na development worker wey dey in her mid-70’s, and she don dey live for Niger for over 20 years.

Posted in Foreign, News, Trending.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *