De Ondo State Government don sack all de eighteen local government chairmo for de state, and deir councilors.

De Deputy Governor Lucky Aiyedatiwa, wey be de acting governor approve de suspension of the council officials as Governor Rotimi Akeredolu no dey around.

Him Chief Press Secretary, Kenneth Odusola-Stevenson naim confirm de development for one statement wey dem issue to tori pipu for de state capital, Akure.

Odusola-Stevenson tok se all de council officials wey dem sack don finish deir di time wey constitutionl allow dem to dey office and dem don direct dem to hand over to di Heads of Local Government Administration for deir councils.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x