Anambra Police Command rescue 9 girls from sex slavery

Anambra State Police Command don rescue nine girls from sex slavery for one brothel wey dey for Awka, Anambra State.

Di police tok tok pesin, DSP Tochukwu Ikenga tok se di girls dem dey between di age of fifteen to twenty-three years.

According to Ikenga, di owner of di brothel bring di girls from Enugu, Ebonyi, Awka-Ibom and Rivers States.

Di Command join bodi wit di State Ministry of Women Affairs and Social Welfare to arrest di owner of di brothel and di girls reveal se dem promise dem jobs and better life for their parents and guidance.

Di command se dem go make sure se di girls dey safe and go back house wit their family.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x