Di National Emergency Management Agency don call de government of eleven states to carri pipu wey dey stay for low-laying areas, as dem dey warn say flood disaster fit happun.

Di states wey e go affect na Benue, Adamawa, Anambra and Rivers,

Odas states na Taraba, Nasarawa, Kogi, Enugu, Edo, Delta and Bayelsa.

NEMA dey raise alarm as dem dey prepare for possible emergency response operations, afta di Nigerian Meteorological Agency dey warn se dis flood disaster wey go affect twenty-nine states and Abuja go heavy.

NEMA officials attend meeting with representatives of di Nigerian Armed Forces, di Federal Road Safety Corps, and officials of di United Nations agencies for Nigeria to talk about di response plans.

For di event, NEMA Director-General Mustapha Ahmed say need dey for all di stakeholders to prepare ahead.

AHMED tok se as Cameroonian authorities don start to release water from di Lagdo dam, e go worsen de flood for Nigeria.


He se based on di information wey dem receive through di Ministry of Foreign Affairs, Cameroon don start to release water from Lagdo dam for de rate of eighteen million cubic meters everyday.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x