Everything don set for APC National Convention

Everything don set for APC National Convention wey dem go take elect the person wey go fly the party presidential flag for 2023 general election.

APC members for all levels dey divided, after the party National Working Committee hear say dem don choose Ahmed Lawan as consensus presidential candidate.

APC National Chairmo, Senator Abdullahi Adamu, been tell NWC members say the choice of Lawan na after him follow Oga Presido Buhari reason well well.

APC National Youth Leader, Dayo Israel, who de for the meeting wey happen for Abuja yesterday confirm the matter, but still tok say NWC no reason the matter or still agree with the decision.

 

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x